Healthy eating is too expensive
Nov 25, 2025 9:06 am
Hey, my persin,
How body?
Someone told me yesterday:
“Doc, abeg leave that healthy eating matter. Na only people wey get money fit do am.”
I just laughed small because I understand where the idea dey come from. But e no true at all.
Look around our markets:
Beans
Ugwu, okro, waterleaf
Sweet potato, cocoyam
Oats, ofada/brown rice
Corn, Millet, Acha
Plantain, Ona, Yam
Groundnuts, fruits in season
These foods no dey too shout, but they are some of the cheapest and most powerful for controlling BP, sugar, and weight, and they’re 100% local!
Truth be told, the real “expensive” thing is not healthy food fam, na hospital bill wey fit follow later if we dey do our body anyhow.
Make we choose better small-small every day. Your body go thank you for am.
What part of eating healthy on a budget do you want me to break down next?
You fit reply me, make i know see if i fit gist you about am?
Till another time my persin.
Hold body well, ok.
Na me, Dr Chinasa